Nana Addo Dankwa Akufo-Addo win de 2020 General elections for Ghana.
De NPP candidate defeat en rival after he poll 51.59 percent of valid votes cast as against John Mahama of de NDC who poll 47.36 percent.
In total Akufo-Addo poll 6,730,413 votes whilst John Mahama secure 6,214,889 of de total votes cast.
Ghana EC Chairperson, Jean Mensa declare de election results in favour of de NPP candidate who to continue en second term as President of Ghana.
Dis be de third time and final time both candidates dey meet in three successive elections.
De younger candidate, John Mahama win one out of three wey de old gun, Akufo-Addo win two out of three contests.
Madam Mensa wey serve as di returning officer, say de final results wey she announce no get that of de Techiman South constituency inside because collation never complete dia.
She even if dem add di total number of Techiman South voters wey bi 128,018, join di result of de second candidate, e no go change final position.
Over 17 million eligible voters participate for de election, wey many don describe as peaceful.
Di election na de first time wey Ghana go do electronic voting, something wey de EC chairperson say Ghanaians suppose dey proud of.
Jubilation don dey happen for de camp of NPP supporters across de kontri.
Akufo-Addo go return to serve im second straight term in office as president.